Crystal say di first day she see her pikin fit stand on her own as dem later install artificial leg for her she cry.

“She wear her school uniform, stand on her prosthetic leg and I begin cry and dey laugh at di same time”, Crystal tok.

She say as she see her daughter begin waka wit di prosthetic leg, she later begin laugh because na freedom for her and her husband.